Mc Godpikin Comic Confrence

Mc Godpikin Comic Confrence I no be small pikin wey start business, run enter market say profit wan kill am. Na me be Mc Godpikin DE comedian.

29/05/2022

Na for Lagos u go see real madman wey go wear suit,hold newspaper for hand,come carry briefcase for head..as people wey correct dey stand for busstop,dey wait for motor wey go carry dem go their destinations,imsef go follow,join dem,dey wait too. The only thing wey fit make u know say na real madman if he stand near u,na im body odour and say u go still confirm say him no get destination at all..na then u go know also say im battery remain just one bar to finish


Yes ooo..anyhow wey E be for dis life,abeg my people make we dey try to dey thank God for the good life wey He dey permi...
29/05/2022

Yes ooo..anyhow wey E be for dis life,abeg my people make we dey try to dey thank God for the good life wey He dey permit and give us everyday..cos na im sure pass and na im be de King of all kings,and de Lord of all lords.
Just a day after my event with the kids on children's day na police (kpokpo) I see for my doorstep wey come wake me up,like play,like laff na so I take find myself inside cell ooo (their lodge). But the most exciting thing wey happen for dis matter wey I dey let una know now be say I no give up on God at all. And as I dey tell una my small experience so,I don come out on bail,and I say may all Glory and Honour be ascribed to God for His mercies to have allowed this case against me today to die and perish like that..WHO I BE..?

14/04/2022
16/03/2022

I dey tell people say no be everybody wey get big chest,na im dey jym..some na people wey dem carry for their minds na im make that their chest dey always big,rise like kpoff kpoff. If u no know,u no go know.

16/03/2022

How yee guys doing ?

21/01/2022

Na me again..u dey look like say u no know me..u see me real..?Abi u no see me at all..?Cos me I don decide to see only those wey see me dis year.
So if u dey there,wey be say u no dey see me before,just hide ur face cos me sef no wan look something wey go make me dream bad dream dis year abeg..cos Obi no go continue to be Boy every year..if He be like so then which day He go become Man na..?So abeg if u no wan see me better hide urself inside ur local kitchen wey u call ur room,cos me I go dey waka dey go,dey go different places,dey see see see things u know,and na so my pocket go dey large dey go Amen,Amen,Amen.

18/12/2021

Na who never go before,na im no go know wetin we wey go see for there

08/08/2021
UPLOADING "DE GOZPEL ACCORDING TO COMEDY IN CHURCH WITH MC GODPIKIN DE COMEDIAN AND FRIENDS"MAKE UNA NO GO OOO..MY PEOPL...
08/08/2021

UPLOADING "DE GOZPEL ACCORDING TO COMEDY IN CHURCH WITH MC GODPIKIN DE COMEDIAN AND FRIENDS"
MAKE UNA NO GO OOO..MY PEOPLE, COS I GO SOON DROP AM.

28/07/2021

We dey ask God to bless us,while some useless ones among us dey one conner,dey pray make their padi man die,so that he no go follow partake for the blessing.
Na God go punish all of them,and put shame for their evil plans against their fellow.
E don taee wey I hear that song,
"One Conner" oo..abi e no dey reign again..??
Una know the matter na.
I no wan shout biko nu.
Na only God go help us for did life.
Cause the street no dey smile, or even dey friendly @ all.
Na God hand we dey shaa.. No shaking.

23/07/2021

Ikenna use im Mama buy Benz o
My guys abeg make una no use una Mama take buy Benz,make she for pray better prayer wey go make better for life.
No go do like useless ikenna.

Address

Maitama

Telephone

+2348054522541

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Mc Godpikin Comic Confrence posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Contact The Establishment

Send a message to Mc Godpikin Comic Confrence:

Share

Category

//iconSize: [32, 32], //html: '' }) .bindTooltip(name, { //permanent: true, direction: 'bottom', //offset: L.point(12, 25), //opacity: 0.88, interactive: true }) .bindPopup(name); markersLayer.addLayer(marker); } function getMore() { if (gettingMore) { return; } gettingMore = true; var center = map.getCenter(); $.ajax({ url: "/vicinitysearch", data: { lat: center.lat, lng: center.lng, country: "NIGERIA" } }) .done(function(data) { var added = 0; data.forEach(function(loc) { if (!locationIds.includes(loc.id)) { var mapLoc = {id:loc.id,lat:loc.latitude,lng:loc.longitude,title:trunc20(loc.name),popupHtml:loc.popupHtml,urlPath:loc.urlPath,pictureUrl:loc.pictureUrl}; locations.push(mapLoc); locationIds.push(loc.id); map._addMarker(mapLoc); added++; } }); }) .always(function() { gettingMore = false; }); } map._clearMarkers = function() { markersLayer.clearLayers(); } }); }, 4000); });