Some History In Pidgin

Some History In Pidgin Some History In Pidgin, is a dedication historical stories about some Africa homes.

09/07/2026

When the News get to the oldest man table for the community, because back in those days, the person when them dey regard as king or president or chairman, na old person when also get power in all ramifications (gerontocracy and plutocratic). The alligation hurt Akpovome so Much. The day when dem summon Akpovome to the eldest man house, he papa come first talk to am that evening; my pikin, I trust you, I nor need to ask you if you do this thing when them dey lie for your head, and who ever the person or people be, I know say one day, breeze go blow and fowl yanch go open. Go my pikin, your ancestors go guide and be your guard. Akpovome mama been nor dey around when the eldest man summon am, but when she come back from farm, na her 4th born nie tell her say, the akpaluku summon Akpovome based on the rumors when dom dey circulate for the community say Akpovome dey sleep with the women when he dey do work for, to fit conceive. The mama come cry out very loud say; unless nor be my ancestors send Akpovome to me, na the only way them go get away with this evil them plan for this my pikin when I carry for my Belle, when remove shame from those family.
Akpovome come reach the Okpaluku house, and he meet other senior men of the community for there.
As them say make them begin talk the matter, nie heavy rain start to blast, all the elders come find their way to their various houses.
Na for the he next chapter we go find out watin happen to Akpovome.

08/07/2026

The urhobo people na one of the most amazing people just like others, when Delta state dom ever produce, and their culture and tradition na very interesting one and na why we go first look into one Papa Akpovome, when dem born in the year 1862. Apkovome na the first son of his papa and na he papa 4th wife nie born am, based on say the 1st, 2nd, and 3rd wife never fit born, na Apkovome nie come open road for other of his siblings. The Ancestors come decide to work through Akpovome, by helping families when dey struggle to get pikin through some natural herbs, growing up, Akpovome go just dey different people for his dreams when dey carry am dey enter inside forest dey go pluck leaves and them dey tell am watin each of the leaves dey work for, so, whenever he wake up, he dey always put to practice watin he see for his dream, and based on the fact say na him be the pikin when open his family way for both fruitfulness and coins, the community nor dey use his wisdom dey play. And watin come dey surprise people the most , be say, Akpovome na just 8years when he start to dey do signs and wonders. Akpovome papa and mama na very good people, them nor ever trade Akpovome divine gift for coins. As Akpovome dey grow, na so the gift self dey grow, and na so he brothers come dey envy am say; how only one person go get all this many gifts?, them come develop hatred for am, till one day when them conspire against am, and them go tell the elderly man for the community (okpaluku), say; Akpovome dey actually sleep with this women he dey give herbs.

We go continue the part 2 for the next chapter.
Stay tuned.

07/07/2026

I greet una my country people, I dey very glad to finally come share some History with Una, and na good thing say we when be Africans, get respect for our culture and tradition, as time dey waka, we go open our eyes to understand things when we need to take live better than the way we Dom first live before. My mama know say I dom first exist many years ago before she born me. I come back to tell some History when even she nor know, abi I go say; maybe she be new person on earth, but that one nor be true because even she herself dom exist before, just that she nor remember a lot of things. Anyways nor be her matter Carry me come.
Make we go straight to history.
Go to my next post for the history of a man when marry 4wives for one day, and watin make am do so.

Address

Warri
Warri

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Some History In Pidgin posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Shortcuts

Share

Category