14/01/2026
π¨ CHAI! Another Wahala Loading! From January 19, Govt Don Dey Chop 7.5% VAT From Your Mobile Transfer & USSD Sharp Sharp! ππ
My people, e be like say dem no wan make we rest at all! Starting next Monday, January 19, 2026, every time you do mobile banking transfer or use USSD to send money, dem go add extra 7.5% VAT on top of the bank charge! Moniepoint don already send message give their customers say na government order, dem must collect am and send give Nigerian Revenue Service (NRS).
You go see am separate for your receipt, but e go pain person well well! Whether na Opay, Palmpay, GTBank app, or *737 #, nothing go escape this one. Card issuance sef dey inside!
Who send this one now? Hunger no dey finish, now dem wan collect more from small small transfer wey we dey manage. Nigerians, how far? Una go accept am like this? Or na another End Bad Governance loading? π€π₯
Drop your comment: This one too much or wetin be your own? Share make everybody know before dem start to deduct!
β¨