DSCG

DSCG Just for fun

27/09/2021

Na for old age ashawo dey know the value ofpikin.
2. Woman wey never see problem... Na im dey still hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.
10. Person wey don faint before no be stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy s*x she dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut s**t.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself
15. Toto water small, but é reach prick take baff.
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
18. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.
21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race don start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.
26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.
28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.
30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am.
32. My thing and our thing no be the same oh.
33. Na happiness dey make prick stand
34. Na as goat sta

19/05/2021

Address

Akure
Akure

Telephone

+2349046849691

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when DSCG posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share

Category