Gud2go9ja

Gud2go9ja gud2go9ja is committed to promoting any good product from Nigeria. . Music, Comedy, Dance, culture,

15/06/2020

Click the Link below for your E-Ticket : and watch the show LIVE on your phone.
http://www.atwxstream.com
Don't miss out...

09/07/2017
14/05/2017
20/04/2017

An employer who allegedly went to demand his unpaid salary from his boss was treated to serious police brutality with passers-by lashing at the officers.

28/03/2017
10/03/2017

PROVERBS IN PIDGIN. JUST TO RELAX THE WEEK.

1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.

2. Woman wey never see problem Na im dey still hold breast run.

3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, na later é go hear am.

5. Na for afternoon dem dey find black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.

7. Eye Wey Dey Cry no De See Road.

8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?

9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.

10. Person wey don faint before no be stranger to death.

11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.

12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains.

13. Yansh no get teeth but e dey cut sh*t.

14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself

15. If Girl Take Husband Do Boyfriend , She GO Take Boyfriend Do Husband .

16. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.

17. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, dem no go sleep outside.

18. Pikin wey say him mama no fine dey use style call him papa blind man.

19. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.

20. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.

21. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.

22. Student Wey Read Na Him Serious , But Student Wey Pass Na Him Know Book .

23. Dem no dey tell tortoise say race don start.

24. Dem no de tell blind man say salt no dey for food.

25. Before you see monkey, monkey don see you.

26. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.

27. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury.

28. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.

29. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.

30. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am.

31. My thing and our thing no be the same oh.

32. Na happiness dey make prick stand.

33. Na as goat stand for market dem dey price am.

34. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.

35. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.

36. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans.

37. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside mama Tope red pot of oil soup.

38. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap.

39. Akara and moi moi get the same parent, na wetin dem pass through make dem different.

40. Mosquito wey stand for blokos na drive dem drive am. Dem no dey kill am.

The Nigerian Senate finally confirms  Justice Walter Onnoghen as Chief Justice of the Federal Republic of Nigeria
01/03/2017

The Nigerian Senate finally confirms Justice Walter Onnoghen as Chief Justice of the Federal Republic of Nigeria

17/02/2017

Address

FCT
Abuja

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Gud2go9ja posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share