17/06/2026
🚨🚨😳😳💔 STOLI OF MY LIFE 💔
3 and 10 go shock wuna 😭💔
1️⃣ Me I no go school the way some people dey think oh 🤔. When I be just 10 years old, I dey Class 4. One of my cousin wey come from Mbireh (Limbe) talk say e need person wey go stay with am, help take care of pikin and still go school.
2️⃣ One evening my papa call me. E tell me say I go Limbe go stay there. You know that village happiness when dem tell you say you don see chance for “outside” 😂👌.
3️⃣ I gree waka. As I reach Limbe for 2008, even though I be dey Class 4, dem send me back go Class 2 😭. I stay there till 2010 before we transfer come back to Ndu. By that time I don reach Class 4 again. As we reach, my papa came from village buy one big Banso bread called (Lookut for road ) came give me for CBC primary school 😅. That time bread 🍞- wetting still be dey worry me small small 😂.
4️⃣ I share the bread with my friends and carry half go house. If you know how that bread be big that time ehh 🤣👌.
5️⃣ I tell my papa say I no like stay there again. E ask me why, but fear no gree me talk.
6️⃣ After my papa go back, second term end, holiday come. I go village for two weeks holiday with only two clothes. No book, no nothing.
7️⃣ As I reach village, I talk straight say I no go back again. My papa ask why, I finally tell am say dem no dey treat me well. Na so I continue my school for village.
8️⃣ Third term dem promote me go Class 5. 2012 I finish primary school. 2013 I start technical secondary school in GTC JIFFA IN MFUMTE . For 2016 I write CAP for Ndu, but result no come out because of the crisis 💔.
9️⃣ I stay village with my papa till 2018. Then e fall sick seriously. One man come recruit people for contract work 250k for 10 months . I collect 25,000 FCFA give am and travel for the job it was to be in Yaoundé .
🔟 This one still dey pain me till today 😭💔. Just two weeks after I start work for Magba, dem call me say my papa don die. As I rush reach village, dem don already bury am. I no even see am for the last time. I no fit tell wuna the pain wey enter my heart that day 💔😭.
1️⃣1️⃣ I cry sotey tears finish. Later I leave village come Douala hustle for better tomorrow. Life don turn me up and down plenty times. Na there I buy my first Android phone and start learn how to read and write better by myself 📱dem still tiff am 2022 i buy a different one start create content 😅🙏.
The story long, I no fit finish am today 😭. If you read reach here, maybe you fit even cry on my behalf 💔.
🙏 Please follow Talkative Palaver . Na there I dey learn every day. I be grateful for everybody wey still support and follow me despite my low level of education ❤️.
I no go school plenty, but life don teach me lessons wey classroom no fit teach. 💔🙏
Thank you for inspiring me 🙏
Fuchor
KIMBI BLOG
J Martin Promo
Itz ode
NexDim Empire
237palava